Nawa-o, my people, I swear my heart dey pain me for these Nigerian youths. E be like say una don carry una destiny throway for gutter, because how una future go dey treated with such disdain and negligence? Every time, dem go tell una stories of a Nigeria wey better pass this one wey una dey suffer inside.
Una mates, children of politicians wey no do half the kind of hustle una dey do for this Lagos sun or Abuja dust, dem dey chop life overseas, shielded from all this wahala of bad governance. Dem no know say garri don turn gold, or say fuel price na daily surprise package.
But the one wey shock me pass, wey make me ask, "Are you people cursed?!" na say some of una, after all the sharp rise in cost of living, after quality of life don fall scatter-scatter, still dey here pledging and brandishing una support for APC. Nawa-o! Wetin happen? Una literally witness how prices just skyrocket, how life just turn upside down, and una still dey shout 'Sai Baba' or 'Jagaban'? For real?
This one no be joke again o. Sometimes I just tire. Getat with that kind of support, abeg. Una no see wetin una dey face? Make una wake up!
