Aproko people, the way this entertainment industry dey do us ehn, e be like Nollywood movie season 7. Serious gbas gbos everywhere!
The Billionaire Paternity Wahala: Davido & Anu Mama
See gist oh! Just when we think the Davido paternity matter don cool down, Baba Imade papa, Dr. Deji Adeleke, just enter social media like Big Boss. He did press conference o!
Wetin he talk? He say the multiple DNA tests wey dem do confirm say our 001 no be the pikin papa, zero per cent probability! Oga Adeleke even talk say the family do multiple tests, one for South Africa, just to clear doubt, and even B-Red dwy involved for the matter to cancel any ojoro.
He threw heavy shade at that aunty journalist (Kemi Olunloyo), say na she dey manage the pikin IG page to dey call for fresh DNA and cause palava. Small pikin wey no be Davido own, dem don even give am 'Adeleke name already. Na wa o! Davido sef just drop one simple 'Thank you' to him dad on X and focus on his #5IVEAliveTour.
But wait o! The pikin mama, Ayo Labinjoh, no gree! She fire back immediately, say na lie say them no do any multiple tests, she accused the Adeleke family of 'intimidation and manipulation.' She still dey insist on a fresh, independent DNA. E be like this matter no go end anytime soon! Table shaker don scatter the table finish.
VDM vs. Wizkid & The Ratel 'Setup' Gist
If you think VDM (VeryDarkMan) na only Davido matter he get time for, you dey bone! The guy still carry enter Wizkid lane and the FC boys dey drag am.
VDM join the Seun Kuti vs. Wizkid fight and warn Big Wiz make he no disrespect Fela Kuti's legacy. He even talk say some Wizkid songs na Fela sample and say the Big Three (Wizkid, Davido, Burna Boy) are not more talented than the legends of the past. Omo! VDM no send anybody papa!
But the main koko of the week! be say - Remember that VDM and BLord serious online fight over the 'Ratel' trademark? The way dem dey drag each other and threaten court? Na full-blown PR setup!
BLord finally open mouth and confess say the whole thing, including the Ratel drama and even the Blunt Gadget Rally, na planned work between him and VDM to get attention for the Ratel App! Ah! So all the online noise na audio?! VDM don turn PR consultant! No be small market strategy be that! You see why you must Aproko well before you take sides?!
Your Take?
- Who you think dey tell the truth for the Davido/Anu DNA matter: Papa Davido or Anu Mama?
- Wetin you think about VDM and BLord turning their beef into a pure marketing stunt? Na smart move or just cruise?
Drop your comments, make we gba gba!
